Woman wey dey deal wit her husband with all the power wey God give am sake sey her husband offend am .
The matter fit be betrayal of trust, i come ask which kain betrayal go make woman come brutal to dey deny her husband sex, care, attention,
so tay wey go dey affect the man emotionally, physically, mentally all join... hmm.. i tire .
Na when some woman go learn say as woman be delecate vessel na so e be for man, becos sey their heart dey delicate pass sef .... if u look am wella una go know sey man no get mind at all small matter for don turn man jelly wey go dey make am draw mio mio.
No be sey i dey hold brief for man o, as una see me i be woman, but wetin i dey talk be say e better make we dey tread matter for man small small, make e no be like say we go dey change man like clothe.
No comments:
Post a Comment